Wen who get sheep kill en sheep, anybody go ponish am? E go sell di meat finish kon sey, ‘Make wi praiz God wey don give us plenty money!’ So who even get sheep, nor dey sorry for dem.”
But wen di pipol wey get di girl si sey wetin dem take dey make money don go, dem seize Paul and Silas kon drag dem go meet di town oga dem for di market centre.
Tins like gold, silva, stone wey dear, beads, fine linen, purpol klot, silk material, red klot and difren tins wey dem take wood wey dear, bronze, iron and marbol make.
Cinnamon, spices, incense, pomade wey dey send well, frankincense, wine, olive oil, flower wey dem take dey make bread, melu, sheep, shariot, slaves and human being soul.
Den dem go pak dust for dia head kon dey kry and mourn: “E bad well-well! Babilon, di big town and where all doz wey get ship for sea dey from get money, bikos na only one hour God take distroy am! E bad well-well for yu!
Bikos en sin bi like drink wey dey shark pesin and na-im make dem dey sleep with who dem nor marry. Na dis make am fall and all di kings for dis eart don sleep with am and many tradas don get plenty money, bikos of di yeye life wey e dey live.”