Some yeye pipol wey travel with Israel pipol, get long-trot for meat and dem kon make Israel pipol dey komplain sey: “How wi wish sey wi fit just get some meat chop!
“But Abraham ansa, ‘My pikin, remember sey wen yu dey alive, yu dey enjoy good tins, but Lazarus nor enjoy at-all. But naw, e dey enjoy for here and yu dey sofa for der.
Yu wont sometin, but yu nor get am; yu dey kill, dey wont wetin oda pipol get and yu nor dey fit get am; so yu go kon dey kworel and fight. Yu nor get, bikos yu nor ask God make E give yu.
Cinnamon, spices, incense, pomade wey dey send well, frankincense, wine, olive oil, flower wey dem take dey make bread, melu, sheep, shariot, slaves and human being soul.