Revelashon 18:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
12 Tins like gold, silva, stone wey dear, beads, fine linen, purpol klot, silk material, red klot and difren tins wey dem take wood wey dear, bronze, iron and marbol make.
Make yu send cedar wood, evagreen and algum trees for Lebanon kon give mi, bikos I know sey yor savants sabi kut trees. My savants go work with yor savants,
So for di vishon, di angel karry mi go wildaness and for der, I kon si one woman sidan on-top one red beast and wetin dem rite for en body, na to curse God. Di beast get seven heads and ten horns.
Di woman wear purpol and red klot kon wear gold for neck. E wear stones and beads wey dear. E hold one gold cup for hand and na yeye tins with sins full inside.