Revelashon 17:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
6 God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.
E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
Yor eyes too dey holy to si bad tins and Yu nor dey like si pipol wey dey do wiked tins. So wetin make Yu dey sorry for dem? Wetin make Yu kwayet wen wiked pipol dey distroy pipol wey good pass dem?
“Wen pesin dey do party, na betta wine e dey first serve pipol, den wen di pipol don drink taya, naim e dey serve cheap wine. But yu kon keep di good wine until di party don one finish.”
I know sey yu dey stay for where Satan throne dey. But yu still whole my name strong well-well and yu nor deny mi even wen dem kill my savant Antipas for where Satan dey stay.