“Dis na wetin e tell mi: ‘Di nomba four beast mean sey di eart go get four kingdom wey go difren from all di kingdoms wey dey before. Dem go skata and distroy di eart.
If dem divide di sky into three, di dragon tail swip one part komot kon trow dem kom di eart. E stand for di woman front as e won born and e dey wait to kill di pikin wey di woman won born.
Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine.
E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.