Revelashon 16:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
2 So di first angel pour wetin dey en basin put for di eart. Den di pipol wey get di beast mark and doz wey dey woship en image kon get sore wey dey pain well-well for dia body.
Instead make dem dey scent well, dem go dey smell. Instead make dem wear betta belt, dem go tie rope for waist. Instead make dia hair fine, hair nor go dey dia head at-all. Na rag dem go dey wear, instead of fine klot. Dia beauti go turn to shame!
God go ponish una with boil from Egypt, some part for una body go swell-up, eczema, ring worm and kro-kro go full una body and dem nor go fit cure una.
Di first angel blow en own and dem kon trow stone with fire wey mix with blood kom di eart. So if dem divide di eart into three, one part burn finish. And if dem divide di trees wey dey di eart into three, one part with all di green grass, burn finish too.
God really attack di pipol wey dey stay Ashdod and E kause betta wahala for dem. God put sore for all di pipol body, both doz wey dey Ashdod and doz wey dey stay near der.