Revelashon 16:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
19 Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine.
I go make pipol wey dey opress una, chop dia own flesh; dem go drink dia own blood like wine. Den evribody go know sey mi, wey bi God, na-im bi di Pesin wey save and free una. Dem go know sey, na mi bi di mighty God for Israel.”
di kings for nort both far and near and all di kingdoms wey dey dis eart. Afta all of dem don drink from God vexnashon cup finish, Babilon king must drink from am too.
Den one from di seven angel wey whole di seven basin tell mi, “Kom make I go show yu how God go kondemn and ponish dat ashawo wey sidan on-top plenty wota.
Bikos di kings nor one join am sofa, dem go stand far dey sey, “E bad well-well! Babilon, di big town wey get pawa! E bad well-well for yu! Na for only one hour God take distroy yu finish!”
E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.