Den God wey dey lead heaven sojas go send en judgement kom with tonda, eartkweke and one loud vois. E go send strong rain and betta fire follow dem too.
“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.
bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.
For dat same time, betta eartkweke go happen and if dem divide di town into ten, one part go distroy finish. 7,000 pipol go die for di eartkweke and evry oda pesin go fear kon bigin tank God wey dey heaven.
Den for heaven, God Temple kon open and en Kovenant Box dey inside di temple. Tonda kon dey make nois and spark, den strong eartkweke happen and big-big ice-blok kon dey fall.
Lite dey shine kom out from di throne and tonda dey make nois from am too. For di throne front, seven tosh wey get fire dey burn for der. Dis na God seven spirit.
Di angel take di basin wey dem dey burn incense put kon pak fire full am from di altar, den e trow am kom di eart and tonda with strong lite and heavy eartkweke kon happen.