Revelashon 16:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 Den di fift angel pour wetin dey en basin put for di beast throne, at wons, darkness kover di beast kingdom and di pain kon dey make dem bite dia tongue.
E shaut with loud vois sey: “E don fall! E don fall! Babilon wey big well-well don fall! E don bikom di place where demons, evil spirits, bird and animal wey pipol hate, dey stay.
Even lantan lite nor go ever shine inside yu again! Dem nor go ever hear sey man and woman dey marry inside yu again. Na yor tradas get pawa pass for dis world, bikos yu take yor majik deceive all di oda kountries!
Den di fourt angel blow en trumpet and wen dem divide di sun, moon and stars into three, dem fall for one part and di part kon dark. So if dem divide day and nite into three, one part for di day nor get sun again and one part for di nite, moon and star nor kon dey shine again.