Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 15:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Den I si anoda big sign for heaven wey nobody go fit undastand: seven angels whole di seven last wahala and na dis ones go komplete God vexnashon.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 15:1
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E dey perform mirakle and wonders for heaven and for dis eart, E dey diliver and save pipol well-well. E don save Daniel from lions mout.”


“If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again.


Den e shaut with loud vois like lion and seven tundas ansa am.


Di sekond deat don pass, but si, di third one go soon kom.


e go drink from God vexnashon wey dey inside en ponishment cup. God go ponish am with fire and sulfur for en holy angels and Lamb front.


So di angel klear di eart with en knife, gada di grapes from di vine kon trow dem put for where dem go press dem and dis na God sirious vexnashon.


Den I hear one loud vois dey tok to di angels from di temple sey: “Di seven basins wey God vexnashon dey, make una go pour dem for di eart.”


Den one from di seven angel wey whole di seven basin tell mi, “Kom make I go show yu how God go kondemn and ponish dat ashawo wey sidan on-top plenty wota.


One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.


Den one for di seven angel wey bin whole di seven basin wey di seven last ponishment full, waka kon tell mi sey, “Make yu kom, so dat I go show yu di woman wey won marry; di Lamb wife!”


Den I look and I hear one eagle dey shaut as e dey fly for sky, “E go bad well-well! E go bad well-well! E go bad well-well for pipol wey dey dis eart, bikos of wetin go happen wen di last three angels go blow dia trumpets.”


Den I si seven angels wey stand for God present and E give dem seven trumpets.


Di seven angels wey whole di seven trumpets dey ready to blow dem.


But di pipol wey dis tins nor kill, nor still gri turn from sin kom meet God wey go save dem. Dem kontinue to serve demon and juju wey dem make with gold, silva, bronze, stone and wood. Dis juju nor dey si, hear or waka.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ