16 So di pesin wey sidan on-top di kloud, take en knife klear di eart kon harvest evritin wey dey inside.
God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work.
Den I look kon si one white kloud and di pesin wey sidan on-top, bi like Man Pikin! E wear gold crown for head kon whole sharp knife for hand.
Den anoda angel kom out from di temple kon tell di one wey sidan on-top di kloud, “Make yu start to harvest with yor knife, bikos na di korrect time bi dis and di fruits for eart don ripe!”
Den anoda angel kom out from di temple for heaven with sharp knife for en hand.
So di angel klear di eart with en knife, gada di grapes from di vine kon trow dem put for where dem go press dem and dis na God sirious vexnashon.