Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 14:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Di smoke from dis sofa go dey go up forever and ever. Doz wey dey woship di beast, en image and doz wey kollect di mark, nor go rest for day or nite.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 14:11
30 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E look face Sodom and Gomorrah side and all di valley, but na only smoke e si wey dey kom out from der.


Na God bi king forever and ever! Di pipol wey nor dey fear God, go vanish komot from dis world.


I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.


Zion pipol wey dey sin, dey fear! Pipol wey nor dey fear God, dey shake. Dem sey, “E get any one of us wey fit survive dat kind fire?”


E go dey burn both for day and nite and smoke go dey kom out from am forever. Nobody go ever fit stay or travel pass di land from one generashon go rish anoda.


God don plan di day wey E go revensh Edom pipol for all di bad tins wey dem do en pipol, Israel.


But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow; en wave nor dey finish and na so-so dirty e dey bring.


Anybody wey nor gri bow woship di gold image, dem go trow am inside hot fire.”


Make I warn una about dat day, bikos blood, fire and smoke go full evriwhere, both for di eart and for di sky.


Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.


“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.


“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”


For dat kountry, una nor go get peace or rest. And God go make una heart dey fear; una eye nor go dey si well and una soul go dey worry.


but koncerning en pikin, E sey: “Yu bi God! Yor kingdom go dey forever and ever and yu go rule yor pipol with authority.


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


E kollect all di pawa wey dey make di eart and evribody woship di first beast (wey en big wound don go).


Di sekond beast still get pawa to give life to di first beast image, so dat e go fit tok and kill doz wey nor gri woship di first beast image.


and make nobody buy or sell anytin, unless e get di beast mark, nomba or name for en body.


Di third angel kon follow di first two, dey shaut: “If anybody woship di beast and en image kon kollect di mark for en fore head or hand,


bigin shaut wen dem si di smoke from di fire wey dey burn di town kon dey sey, “Who get pawa rish dis big town, Babilon?”


Den di kings for dis world wey follow am kommit sin and enjoy yeye life, go kry kon shaut for am wen dem si di smoke from di fire wey dey burn am.


Den di pipol shaut again, “Halleluya! Di smoke from di fire wey burn am go dey go up forever and ever!”


Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.


Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.


Dem kon dey sey: “Make praiz, glory, wisdom, tanks, honor, authority and pawa bi awa God own forever and ever. Amen!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ