“As I still dey look di horn, I si anoda small horn dey kom out from di big wons and three of di former horn kom skata make dis ones for fit kom out. Dis horn get eye wey bi like human being own and mout wey e take dey tok anyhow.
I look up kon si one ram wey get two horn and e stand near di river. Di two horn long, but one long pass di oda one. Di one wey long pass, kom out afta di short one.
Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.
Di dragon dey vex for di woman, so e kon decide to fight all di shidren wey di woman born, dat is, evribody wey keep God kommandment and bilive Jesus Christ.
Den I si one beast dey kom out from di sea. E get ten horns, seven head and ten crowns dey en horns. For en head, name wey dey curse God, naim dem rite put.
Dem dey woship di dragon, bikos na-im give di beast pawa to take rule. Dem dey woship di beast sey, “Who bi like di beast? Na who fit follow am fight?”
God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.
Di beast wey yu si, dey before, but e nor dey again and e go soon raiz kom from di pit kon start to distroy. Den doz pipol for eart wey dia name nor dey for di Life Book, go fear di beast.