But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years.
If dem divide di sky into three, di dragon tail swip one part komot kon trow dem kom di eart. E stand for di woman front as e won born and e dey wait to kill di pikin wey di woman won born.
So for di vishon, di angel karry mi go wildaness and for der, I kon si one woman sidan on-top one red beast and wetin dem rite for en body, na to curse God. Di beast get seven heads and ten horns.