Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Revelashon 10:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 I dey ready to rite wen di seven tundas dey tok, but I hear one vois from heaven dey sey, “Anytin wey di seven tundas tok, make yu keep am as sekret and nor rite dem at-all.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Revelashon 10:4
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

To una, evritin wey di profet tok, bi like word wey dem rite for book kon klose am. Wen dem gi-am to pesin wey sabi read kon sey, “Read am,” e go ansa, “I nor fit, bikos dem klose am.”


God tell mi, “Make yu take one big board kon rite dis tins put, ‘Maher-Shalal-Hash-Baz.’ ” (Wey mean, “Kwik Karry Make Yu Distroy Fast-fast.”)


Una wey dey follow God, make una guide and keep di message wey E give mi.


“But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”


E ansa, “Daniel! Make yu dey go. Dis matter don finish and dem don keep am until di world go end.


Di vishon about morning and evening wey dem tell yu, korrect. But make yu keep di vishon for yor mind, bikos di time wey e go happen, neva rish.”


Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.


“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”


So make yu rite wetin yu si: both doz wey go happen naw and di ones wey go happen leta.


Den di vois from heaven tell mi again, “Di angel wey stand for wota and land, make yu go take di book wey dey en hand.”


Den e tell mi, “Nor klose di words wey dey dis book, bikos di time don near.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ