2 E hold one small book wey open for en hand and e stand with en rite leg on-top sea kon put en left leg for land.
Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.
Yu really ansa awa prayers wen Yu show us how Yu take dey save and diliver us. Di whole eart trust Yu; plus pipol wey dey di oda side for di sea.
From east go rish west, evribody go fear en and en great pawa. E go kom like river wey dey rush well-well and like strong breeze wey dey blow.
Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.
Den di angel wey stand for di sea and land, raiz en rite hand go heaven.
As I dey look, di Lamb kon open one for di seven keys and I hear one for di for creatures dey shaut like tonda sey, “Make yu kom!”
Wen di Lamb open di sekond key, I kon hear di sekond creature dey sey, “Make yu kom!”