8 Make di rivers klap dia hand as dem dey praiz God. Make di hills sing dia song for joy
Jehoiada bring di king pikin kom out kon crown and gi-am God laws. Den dem make am king, anoint am kon klap dey sey, “God save di king!”
Evribody! Make una kom! Make una klap una hand! Make una shaut praiz God with klean mind!
Na Yu kreate di nort and sout. Mount Tabor and Mount Hermon dey praiz yor name.
Pawa dey yor hand; yor hand strong well-well! Wons Yu raiz yor rite hand wey get pawa, Yu dey always dey win.
My Oga God, even doh rivers dey full and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,
Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.