7 Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God! Make di eart and evry living tin join dem too.
Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.
Make di heavens and di eart dey happy! Make di sea and evritin wey dey inside, shaut praiz God!
So heavens make una shaut for joy! Eart, make una shaut dey happy! Make di mountins bigin sing, bikos God go konfort en pipol kon sorry for di ones wey dey sofa.
Just as seed dey take grow, na so God wey bi king, go take save en pipol and all di nashons go praiz am.