Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 97:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Pipol wey dey fear God, lite dey shine for dia body and doz wey get pure heart, dey always happy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 97:11
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jew pipol kon dey happy well-well and belle sweet dem.


Yor life go shine pass aftanoon sun and di dark hours for life, go give yu morning lite.


Yu go prosper for evritin wey yu dey do and lite go shine for yor way.


Even for darkness, lite dey shine for pipol wey dey fear God. Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet.


Yu lite one lamp for mi. Na di Oga my God put lite for my darkness.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


Raitious pipol ways bi like sun for morning wey dey shine well-well go rish evening.


Den my favor go shine for una body like morning sun and una sore go kwik heal. I go always dey to save una and my present go protet una for evriwhere.’


I nor go rest bikos of Zion and bikos of Jerusalem I nor go kwayet until en raitiousness go shine kom out like morning lite and en salvashon like tosh wey dey shine well-well.


I go dey patient as God dey ponish mi, bikos I don sin against am. But afta E don ponish mi, E go fight for mi kon make mi win. God go take mi enter di lite and I go si en raitiousness.


I kom as lite for dis world, so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.


bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.


Di town nor nid sun or moon to shine, bikos God glory dey shine put and na di Lamb bi en lite.


Nite nor go dey again and dem nor nid lantan or sun lite, bikos God go bi dia lite and dem go rule forever and ever with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ