My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
But as tins bi so, dem dey espect kountry wey betta pass dia own and e dey kom from heaven. Naim make God nor shame wen dem dey koll am dia God, bikos E don build big town for dem.