God tell en pipol, “Make una stop and look round. Mi, wey bi God, don tok. Ask for di old way wey bi God own and make una follow am.” But dem ansa, “Dat nor bi di way wey wi like to follow!”
I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.
Na only wi wey bilive go fit enter di place where God rest dey, bikos God sey, “I vex kon swear for dem, so ‘Dem nor go ever enter my place where rest dey!’ ”
Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins: “God don bless pipol wey bilive and obey Christ before dem die!” Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”