22 But na God bi di place where I hide put; na my God mi di mighty rock wey dey hide mi.
Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.
Na Yu bi my strent and I dey wait make Yu save mi! Na Yu God, bi my guide!
Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.
My pipol, make una always dey trust God, bikos na en dey guide us.
Na God dey guide doz wey dem dey opress; na-im dey save dem wen trobol kom.
If E fit ponish wiked nashons, una tink sey E nor go ponish una? E know evritin, so make una nor tink sey E nor know wetin una dey do.
na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.