Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 94:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Dem dey plan against di pesin wey dey do wetin dey rite kon kondemn and kill innocent pipol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 94:21
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”


Dem plan kon stone Zekaraya die for God kourtyard.


Dem kill innocent pipol kon sakrifice dia sons and dotas give Kanaan juju, so di land kon full with innocent pipol blood.


My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi. Dem don shuk my hand and leg.


Dem dey gada hide dey look mi; dey monitor mi as I dey waka and dem dey ready to kill mi.


My God, si as dem dey wait for korna to katch mi; wiked and strong men dey wait to katch mi, even doh I nor sin or do bad tin.


“Make una nor akuiz pesin for wetin e nor do and make una nor kill good pesin, bikos I nor go free anybody wey do like dat.


If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin! Make wi just go attack some innocent pipol!” Make yu nor listin to dem.


Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill.


God nor like pipol wey dey defend wiked pipol and kondemn doz wey dey innocent.


But make una know sey, if una kill mi, una and di pipol for dis town nor go get rest, bikos una don kill innocent pesin wey God send kom warn una.”


Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.” Dis na wetin God wey get pawa tok.


Pipol wey dey rule bi like wolf wey tear animal into too. Dem dey kill pipol, so dat dem go get money.


“All di leaders for Israel trust dia pawa and dem dey kill pipol.


Abeg, awa king, make yu give and sign dis orda, so dat nobody go fit shange am and e go bi like Mede and Persia Law wey nor dey shange.”


For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus.


kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!” But dem sey, “How dat one take koncern us? Na yor business bi dat.”


E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’


Yu don kondemn and kill pipol wey nor do bad, bikos dem nor fit stop yu.


God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ