19 Wen I dey fear sey evritin don finish for mi, Yu kon konfort, give mi new hope and make mi trust Yu.
From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help, bikos trobol don make my heart heavy. Karry mi go di high mountin, where I go for dey save.
I nor go ever forget di time wen I take sofa; wen I bin dey mourn, bikos of evritin wey I lost.
I tell mysef sey, “Na only God I get, so I go trust only en.”