Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 94:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Yu dey free dem from trobol and dem go dig pit wey go katch dia enemies.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 94:13
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.


So, wetin go make mi fear wen trobol kom or wen enemies gada round mi?


But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.


Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.


Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.


Make tif karry evritin wey dem get for dia house, so dat dem go kry well-well. Bikos dem don dig whole make I fall put kon set trap make e katch mi.


I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.


So, di really “Sabat Day” rest, still dey kom for God pipol.


If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.


Di nashons dey vex, but di time wey yu go ponish dem, don rish. And na naw yu go judge doz wey don die kon reward yor savants; di profets; doz wey dey good and evribody wey dey fear yor name, both small and big. Dis na di time to distroy doz wey dey kause wahala for di eart.”


Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins: “God don bless pipol wey bilive and obey Christ before dem die!” Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ