So make yu put yor hope for Oga God. Make yu dey always waka for en ways and E go honor yu wen E give yu dis land, den yu go si as E dey distroy wiked pipol.
Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.