12 So make Yu tish us, so dat wi go know sey wi bi ordinary human being, den awa wisdom go dey grow more-more.
God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
“My God, na how long I go dey dis life? Wen I go take die? Make Yu tell mi wen my life go end.
Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu. True-true, evribody life just bi like breeze wey dey blow pass.”
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,
Make yu listin to yor tishas kon learn evritin wey yu fit learn.
Make yu do anytin to get wisdom, trut, undastand and good sense and if yu get dem, make yu nor sell dem, bikos dem go help yu well-well.
Ask for wisdom and undastandin! Nor forget or abandon wetin I tok.
Na wisdom bi di best tin to get. If yu go get any oda tin, make e bi undastandin.
E betta to go house where dem for dey kry dan to go where dem for dey celebrate; bikos evribody go die one day. So make pipol wey still dey alive put dis one for dia mind.
So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.
I must do di work for di Pesin wey send mi before day go dark, bikos nite dey kom wen nobody go fit work.
How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins or know wetin go happen to dem.