Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 90:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Na seventy years Yu give us! Some pipol even dey rish eight years. Even di estra years wey human being dey live, na pain and trobol full am; but di years go soon disappear and wi go fly go.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 90:10
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.”


So Oga God kon sey, “My Spirit nor go fit stay with man again pass one hundred and twenty years, bikos dem bi ordinary human being.”


I don old rish eighty years and nor-tin dey make mi happy again, I nor dey taste or enjoy wetin I dey chop or drink and I nor dey hear pipol wen dem dey sing again. So if I follow yu go, na wahala I go just bi to yu.


Dat kind big reward nor fit mi. So I go follow yu pass Jordan River small.


Naw, David don old well-well and even wen dem kover am with klot, kold go still dey katch am.


But if pesin die, na di end bi dat. Dem don die; so where dem dey naw?


Dem go vanish like dream and vishon for nite and pipol nor go si dem again.


Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.


But just as lite dey shine go up, na so too dem born pesin enter trobol.


bikos E remember sey na ordinary human being dem bi. Dem go just die go like breeze wey nor dey kom back again.


Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.


If di pesin na from sixty years go up, if na man, na fifteen shekel and woman, na ten shekel e go pay.


“But God kon tell di man, ‘Yu bi fool! Dis nite, yu go die, den who go kon get all dis tins wey yu don gada for yorsef?’


Moses na one hundred and twenty years wen e die, but en eye still klear and e still strong like yong boy.


but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.


Yet, I still strong like wen Moses send mi go spy. I fit still fight kon do my evriday work with di same pawa wey I get dat time.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ