Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
Egypt pipol nor bi god! Dem bi ordinary human being. Dia horse na just flesh nor bi spirit! God go distroy dem with en hand. Di pipol wey dey help dem, go stagga and di ones wey dem dey help, go fall for groun and all of dem go die togeda.
I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.
“Man pikin, go tell Tyre king wetin mi God wey get pawa dey tell am: “Yu dey proud and yu dey sey yu bi god wey sidan for throne and sea dey round yu. Yu fit pritend sey yu bi god, but make yu know sey na human being yu bi and nor bi wetin yu tink.
Wen dem dey kom kill yu, yu go still tok sey yu bi god? By di time yu go si di pipol wey won kill yu, yu go know sey yu nor bi god, but na ordinary human being yu bi.
From today, evribody wey dey di world, I go put fear for dia mind, bikos of una and even wen dem hear una name, fear go katch dem. Dem go fear nearly die wen dem hear sey una dey kom.”