Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 9:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 My Oga God, make Yu raiz-up! Nor let wiked pipol win! Make Yu kom judge di nashons.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 9:19
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”


King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”


So my God, make Yu raiz-up kon ponish wiked pipol! Make Yu nor leave doz wey nor get who go help dem!


so dat dem go fit revensh dia enemies kon ponish di strenjas.


My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!


So, my God, make Yu wake-up! Wetin make Yu dey sleep? Make Yu get up! Make Yu nor rijet us forever.


So my God, make Yu kom help us! Save us bikos of yor love wey nor dey fail.


My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!


Make Yu pour yor vexnashon for di nashons wey nor dey respet Yu; di kingdoms wey nor dey koll yor name,


to Efraim, Benjamin and Manasseh pipol. Make Yu show yor mighty pawa, den kom save us!


Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.


Make Yu vex well-well for di nashons wey nor gri woship Yu and doz wey rijet Yu, bikos dem don kill and distroy yor pipol finish kon turn awa land to desert.”


Di pipol must ready kom Jehoshafat Valley. Na for der mi wey bi God go sidan judge all of dem.


I go revensh and ponish all di nashons wey nor gri obey mi.”


So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.


If Egypt pipol nor gri celebrate Shelta Feast, di same diziz wey God send go all di nashons wey nor gri celebrate di feast, go katch dem too.


One sharp swod dey kom out from en mout and e go take am distroy all di kountries. E go rule dem with strong hand and E go mash di grapes wey dey bring wine with strong vexnashon, bikos na God get all di pawa.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ