6 My God, na who pipol won take kompare Yu for all di heavens? E get any angel wey bi like God?
Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne?
Make all di angels for heaven honor God; make una honor am, bikos of en glory and strent.
My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?
My God, yor good judgement dey rish di heavens and Yu don do many wonderful tins, so na who bi like Yu?
Na who I get for heaven escept Yu? I wont Yu more dan anytin for dis eart.
My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!
My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good.
My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?
I sey, “My God! Nobody bi like Yu. Yu dey mighty and yor name dey great with pawa.