48 Evribody go die, bikos nobody fit stay forever and nobody go fit run from grave pawa.
I know sey Yu dey karry mi go where I go for die; di place wey Yu keep for evribody.
So, na how long I go dey wait? Na wen Yu go ponish di pipol wey dey wahala mi?
Make rish pipol for di world kom woship am. Evribody must bow to am, plus doz wey don die and doz wey nor fit save dia own life.
Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.
But for mi, God go save my life. E go save mi from deat.
By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
Wi nor fit kontrol breeze or tok di day wen wi go die. Dat na one war wey wi nor fit run from and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.
Pipol wey dey alive naw, know sey one day dem go die, but pipol wey don die, nor know anytin and dem nor get any reward again; pipol nor dey remember dem again.
I dey tell una true word, if anybody follow wetin I dey tish, e nor go die again.”
bikos I know sey God nor go allow mi stay for grave or make my body rotin for groun.
Wi do like dis, bikos wi know sey di Pesin wey raiz-up Jesus, go still raiz us up with Jesus and E go take wi and una enter en kingdom.
Na faith nor let Enoch die, but God karry am take and nobody si am. God word sey, before God karry am, Enoch don make belle sweet God.
Bikos God sey, na only wons man go die and afta dat, judgement go kom,