45 Yu don make am old before en time kon disgrace am for publik.
And na since den Israel pipol for nort bigin fight against David kingdom.
E don take my strent, even doh I still dey alive! E don make my days for di world, short.
Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.
Na sofa and curse bi my own evriday; dem don rite shame put for my fore head.
Make Yu disgrace and distroy pipol wey dey akuiz mi. Make disgrace and shame follow pipol wey won kill mi.
Na small time wi spend for yor house before awa enemies drive us kon skata yor temple.
God disgrace Zion bikos E dey vex. E don trowey Israel pride from heaven kom down and E nor protet di temple again bikos E really dey vex with dem.
Den my enemies go si sey God dey for my side and shame go katch dem. Dis na di same enemies wey ask sey, “Where dat yor Oga God dey?” And naw, I go si as dem dey fall and I go mash dem pass like portor-portor for road.