40 Yu don break di wall wey dey guide am kon distroy evritin wey dey protet am.
For dat time, nobody fit travel as e like, bikos trobol dey evriwhere for di land.
Yu dey kover en, en family and all di tins wey e get; Yu bless evritin wey e dey do and Yu don gi-am plenty animals.
E don take all my glory kon distroy my respet.
But naw, wetin make Yu break awa walls so dat evribody wey dey pass go fit tif awa fruit?
God nor sorry for Jakob shidren-shidren, instead E distroy dia house. Wen E dey vex, E break Jerusalem strong fine wall kon disgrace di kingdom with doz wey dey rule am.
God distroy Israel like sey E bi awa enemy. E distroy all di palis dem kon skata awa betta towns. E make evribody for Judah kry and mourn.
Una go feel my vexnashon like hot fire. And I go give una to wiked men wey sabi distroy tins.