35 Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie:
God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”
God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.
Bikos God dey holy, E don promise sey, “Di day dey kom wen dem go karry all of una go for inside basket like fish wey hook katch.
Naw, Oga God swear with en name sey: “I nor go forget all dis evil tins wey una don do.
God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.
But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.
Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.
Nobody big pass God, bikos God swear with en name wen E promise Abraham sey,
So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.