Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 89:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Yor love wey nor dey fail go last forever. Yor goodness dey forever like di heavens.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 89:2
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Oga God for heaven! Yu big well-well and wi dey fear Yu. God wey keep en promise with doz wey love and dey do wetin E kommand.


Dem nor gri obey; dem forget all wetin Yu don do; dem forget di mirakles wey Yu do and bikos of dia pride, dem choose leaders wey take dem go back to Egypt as slave. But Yu bi God wey dey forgive. Yu dey good and dey sorry for pesin. Yu nor dey kwik vex and yor royal love nor dey fail. Yu nor abandon dem at-all


But bikos of yor great mesi, Yu nor distroy dem finish or abandon dem forever. Si as Yu dey good and dey show mesi!


But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren;


My God, yor word wey dey forever, stand gidigba for heaven.


Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make.


My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens; just as yor goodness high pass di kloud for sky.


So Oga God, make Yu nor stop to dey sorry for mi. Make yor love and faith wey nor dey fail, always dey protet mi.


My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.


E go dey forever like di moon and di sky go bi witness to show how I really dey faithful!”


So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.


God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.


Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.


E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.


God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ