Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 89:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 89:18
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”


E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am. So make wi praiz God!


Na Yu bi my King and God. Na Yu make Israel pipol win.


Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol, but bikos na God bi di King of evry king, make una honor am for evriwhere for di world.


Na-im bi my Rock and Salvashon; di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.


Den I go praiz Yu with harp, bikos Yu dey faithful to yor promise. My God, I go use jita take sing praiz Yu wey bi di Holy One for Israel.


Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.


Una own don finish like who don die, bikos una pipol dey kommit sin. Una don spoil finish and dey do evil tins! Una sins dey bring una down, bikos una don rijet di Holy Pesin, wey bi Israel God kon turn against am.


Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.”


Poor pipol and doz wey honbol diasef go si di happiness wey di Oga wey bi Israel pipol God, dey give.


“Nor do good again, but make yu kom join us. Make yu nor tell us about di Holy One for Israel again.”


Bikos God wey bi awa ruler, kommander and king, go diliver us.


Israel God wey dey holy, wey save una sey, “Bikos of una, I send sojas go Babilon kon break di town gate and di pipol happiness kon turn kry.


Bikos na Mi bi di Oga wey bi una God. Israel pipol God wey dey holy, wey save una. I go sell Egypt, Sudan and Seba pipol, so dat una go dey free.


Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ