Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 89:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 I go always dey sing about God love wey nor dey fail! Both yong and old pipol go hear about how God good rish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 89:1
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na-im wise pass among all men. E wise pass Etan wey kom from Ezra and Heman, Kalkol, Darda wey bi Mahol shidren. So pipol kon dey tok about Solomon wisdom for all di kountries wey dey near Israel


and Solomon dey give Hiram 100,000 bucket for wheat and 110,000 gallons for pure olive oil evry year make e take feed en men.


Zera sons na: Zimri, Etan, Heman, Kalkol and Dara.


My God, I go sing about yor love and how Yu dey judge! I go praiz Yu with difren song.


Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good! E love wey nor dey fail, dey forever.


Yu dey good to all generashon and na as Yu kreate di eart, e still dey kon rish naw.


My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens; just as yor goodness high pass di kloud for sky.


But for mi, I go sing about yor pawa. Evry morning, I go sing with joy about yor love wey nor dey fail, bikos na Yu bi my guide; di place where I dey hide wen trobol kom.


Dat na why I nor fit stop to praiz Yu and I go dey tok about yor glory evriday.


Pipol wey dey grave go fit tok about yor love wey nor dey fail? For where dem dey naw, dem go fit tok about how Yu good rish?


My goodness and love wey nor dey fail, go dey with am and with my authority, e go grow with pawa.


But I nor go stop to love am or forget di promise wey I make with am.


So my God, where all di good tins wey Yu bin do for us; di ones wey Yu do just as Yu promise David?


My Oga God wey dey rule evriwhere! Nobody dey strong like Yu, bikos Yu always dey do good.


For morning, e dey good to tok about yor love wey nor dey fail and for evening, wi go sing of yor faithfulnes,


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


Wi dey always trust Yu bikos na evriday Yu dey show us yor goodness.


Just as Yu promise awa grand-grand papa, Abraham and Jakob, na so too Yu go show us yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ