7 Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
If I sey make I karry body up, Yu go porshu mi like lion and na mi Yu go use take show yor pawa.
God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.
Both day and nite, God just dey ponish mi. My strent die go like wota wey dry, bikos of heat.
My God, make Yu nor porshu or ponish mi, bikos Yu dey vex!
I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.
I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.
Yes, yor vexnashon dey kill us and Yu dey make us fear as Yu dey vex.
Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.
Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’
Pesin wey bilive di only pikin wey God get, go get life wey nor dey end. But pesin wey nor bilive Man Pikin, nor go get life at-all. God go always dey vex with dat kind pesin.”
E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”