18 Yu don allow pipol wey I love and doz wey love mi, dey run from mi. So, na darkness bi my best friend naw.
Wiked nashons gada around mi, but I distroy all of dem with God pawa.
Yes! Dem gada round kon attack mi, but I distroy all of dem with God mighty pawa.
All my enemies dey laf mi and my neighbours hate mi; even my friends dey fear to waka near mi and wen dem si mi dey kom, dem go rush pass anoda road.
Pipol wey I love and wey bi my friends, dey run from mi, bikos dem dey fear my diziz. Even my own family membas stand for far dey look mi.
Yu don porshu my friends kon fool mi for dia front and naw, I dey for trap wey I nor go fit run komot.