15 Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life.
“My spirit don weak well-well and my life go end just naw. Na grave dey wait mi naw.
God, I dey koll Yu, but Yu nor gri ansa and wen I pray, Yu nor gri listin to my prayers.
God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
bikos na Yu bi di God wey dey save mi. But wetin make Yu rijet mi? Why I go dey waka with pains, bikos my enemies dey opress mi?
Wi don faint for groun kon sleep for dirty.
Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.”
Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.
Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.
God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol
Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.