16 Make Yu turn face mi kon sorry for mi! Make Yu give yor pawa to yor savant, den diliver pipol wey dey obey Yu.
My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.
Make Yu kom show mi yor mesi, just as Yu dey do to evribody wey love yor name.
I bi yor own, so make Yu save mi, bikos I don work well-well to obey yor kommand.
Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.
Make Yu turn kon sorry for mi, bikos na only mi dey and I dey sofa well-well.
Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi. Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?”
My God, make Yu ansa mi, bikos yor love wey nor dey fail, dey good and bikos of how Yu dey sorry for pipol, make Yu turn face mi!
Pipol wey get pawa thru Yu, si as dia blessing big rish too. Dem like to always go yor temple!
My God, make Yu kom back to us! Na how long wi go dey sofa like dis? Make Yu kom sorry for yor savants!
Dem go sey, ‘Yes! Na only God get pawa to save pipol and anybody wey hate am, na disgrace go follow dem.’
I go make my pipol strong and dem go woship and obey mi.” Mi, Oga God, don tok.
Mary kon sey, “Yes, I bi God savant, make wetin yu tok so, happen to mi.” Den di angel kon leave am.
I dey pray sey as en glory big rish, E go make una strong well-well with pawa thru en Spirit wey bi di really pesin inside una.
Finally, make una dey strong with Christ mighty pawa.
I fit do evritin thru Christ wey dey give mi pawa.
Wi still dey pray sey una go dey strong with God pawa wey get glory. Una go show sey una dey patient and get strong mind for God work with happiness.