Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 86:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 bikos Yu big well-well and dey do wonderful tins. Na only Yu bi God,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 86:10
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu fit find out where God from kom? Or how E take dey get en mighty and strong pawa?


Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.


My God, no oda god bi like Yu. No one fit do wetin Yu dey do!


My Oga God! Who bi like Yu among oda gods? Who bi like Yu? Di One wey dey holy, wey dey do mirakles and great tins?


“Israel God wey get pawa; di Pesin wey sidan for where high pass di creatures wey get feadas. Na only Yu bi God wey dey rule all di kingdoms for dis world. Na Yu kreate di eart and di sky.


Naw, Oga wey bi awa God, make Yu save us from Assyria pipol, so dat all di nashons for di world go know sey, na Yu bi God.”


Na mi bi God, no oda god dey wey bi like mi. I give una pawa, even doh una nor know mi well.


Jesus ansa am, “Na dis bi di kommandment wey big pass: ‘Make una listin, Israel pipol, di Oga God, awa God na one e bi.


anytime wen wi koll Yor holy pikin Jesus Christ name, make yu heal pipol and do many wonderful mirakles.”


So, even if pipol dey offa food give juju, all of us know sey di juju dem nor get life, bikos na only one God dey.


one God and Papa wey dey above evribody; dey use evribody and dey inside evribody.


God sey, “Na Mi, bi Mi! And e nor get any oda god escept Mi. I dey kill and give life, I dey make pesin sick and heal pesin too and nobody go fit fight mi.


God use signs, mirakles and wetin di Holy Spirit do, take show sey, dia words na true.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ