2 I really love to dey di kourt wey dey God temple. My heart and my whole body dey shaut for joy, bikos of God wey dey alive.
If to sey I know where I go for si God and how to go where E dey,
I always dey happy to dey learn yor rules and laws.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
I lift my hands and pray to Yu. Just as dry land dey hongry for rain, na so too I dey hongry to si Yu.
My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.
So Jerusalem wimen, make una promise mi sey: If una si my love, una go help mi tell am sey, en love don make mi dey sick.
I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.
How I wish Yu go tear di sky open kon kom down from heaven! Di mountins go si Yu kon shake with fear.
‘Si as Israel tent fine, di place where Jakob dey stay!