16 Make awa enemies nor chop and burn us finish. Make dem die, bikos Yu nor dey happy with dem.
Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.
My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?
Yes, yor vexnashon dey kill us and Yu dey make us fear as Yu dey vex.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
Anybody wey nor stay inside mi, go dry and pipol go gada en branches dem, trow and burn dem inside fire.
God go distroy dem and dia ponishment nor go ever end. Wen Christ go kom receive glory from di pipol wey e choose,