And naw, Oga God sey, na mi kreate and form yu from yor mama belle as my savant, so dat yu go bring Jakob, my pipol kom back to mi kon gada Israel togeda. Dis na bikos Oga God don honor mi and na-im bi my strent.
Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.
Joshua di High Priest and all di priests, make una listin to mi, na una bi my sign about wetin go happen; bikos I go soon bring my savant, wey bi di Branch!”
Jesus kon tok to dem with parabol: “One man plant grape for en farm. E fence am round, dig where dem go dey press di wine put, den kon build big house wey guide go dey stay. E hire am give tenants wey go dey kare for di farm kon travel go far.
Naw, make Yu look down from yor holy house for heaven kon bless Israel wey bi yor pipol and di land wey Yu promise awa grand-grand papa sey, Yu go give us. Di land wey full with milk and honey.”