14 Awa God, di Warrior wey nobody dey si, wi dey beg make Yu kom back. Make Yu from heaven look kon si di wahala wey wi dey face. Make Yu kare for dis grape tree
Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.
Why Yu make us komot from yor plans and ways? Why Yu make us sturbon like dat, sotey wi turn from Yu? Make Yu kom back, bikos of doz wey dey serve Yu and bikos of di pipol wey bi yor own.
Na from una grand-grand papa time, una don turn komot from my law and nor gri obey mi. Make una turn back kom meet mi and I go turn kom meet una. But una dey ask, ‘How wi won take turn kom meet Yu wen wi neva leave Yu before?’