12 But naw, wetin make Yu break awa walls so dat evribody wey dey pass go fit tif awa fruit?
King Hiram for Tyre, na David friend, so wen e hear sey Solomon don bi king afta en papa, David, e kon send some pipol go meet am.
Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard: I go remove di fence wey dey round am kon break di wall wey dey protet am. I go let animals chop and mash am anyhow.
Judah and Israel pipol bi like tree wey en enemies break en branches, but Oga God go make dem grow again kon give dem glory and pawa.
E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.” Wen di pipol hear dis, dem kon sey, “Make dis tin nor happen o-o!”