11 Make Yu listin to di prisonas kry. Make Yu show yor great pawa kon save doz wey pipol sey dem must die.
to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.
So, make evribody for Zion celebrate God greatness and make dem praiz am for Jerusalem
So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
God dey listin to doz wey nor get help and E nor go forget en pipol wey dem dey ponish.
So my God, make Yu sorry for us, bikos na Yu wi put awa hope on. Make Yu dey protet us evriday kon save us from trobol.
Yu go open blind pipol eyes, save doz wey dey darkness and free doz wey dey prison.
Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’
So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us.