Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die.
David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”
So make yu tell David wey bi my savant sey, di Oga God sey, ‘I take yu komot from where yu dey kare for animal kon make yu rule Israel wey bi my pipol.
So God, make Yu save yor pipol! Make Yu bless Israel pipol wey bi yor special propaty. Make Yu guide dem like shepad kon karry dem for yor hand forever.
“ ‘Betlehem pipol, una wey small pass for all di pipol wey dey rule Judah, na from among una di pesin wey go lead all my pipol for Israel, go from kom.’ ”
Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.
Den Samuel take one kontaina wey get olive oil kon pour am for Saul head. Samuel kiss am kon sey, “God don choose yu make yu lead en pipol, Israel! Yu go rule and diliver dem from dia enemies wey dey round dem. Dis go bi di sign sey God don choose yu as leader ova en propaty.